Many of you might have seen this before, but I received it in my inbox today and it made me laugh. For non-nigerians it is written in broken English so might not be easy to understand.
The Lord Na my shepherd, I dey kampe.
E make me Sidon for where betta dey flow and come put me next to
stream make mai bodi thermacool.
E panel beat mai soul come spray am white, come dey lead me dey go
through express road of righteousness sake of Hin name.
Walahi !, if I waka pass where arm robber, 419 and juju people boku,
come even join okada reach valley of the shadow of death sef, mai bodi
dey
inside cloth.
Your rod and staff nko? Na so dem dey like back bone dey comfort me.
You don prepare Egusi, Efo and Pounded yam make I chop. All mai
enemies dey look waa waa. You rub me for head wit Vaseline intensive
lotion. Mai cup Na River Niger wey overflow hin bank.
True true, betta life and mercy go gum mai back till I quench. And
man pikin go tanda for God house from lai lai to lai lai.
Thursday, 24 May 2007
Subscribe to:
Post Comments (Atom)
No comments:
Post a Comment